AWR- Voice wen dey ginger Hope

Follow AWR- Voice wen dey ginger Hope
Share on
Copy link to clipboard

AWR Pidgin English

Adventist World Radio


    • Jan 1, 2026 LATEST EPISODE
    • daily NEW EPISODES
    • 29m AVG DURATION
    • 1,867 EPISODES


    More podcasts from Adventist World Radio

    Search for episodes from AWR- Voice wen dey ginger Hope with a specific topic:

    Latest episodes from AWR- Voice wen dey ginger Hope

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Jan 1, 2026 29:00


    As today na new year, we dey salut hawa pipo and dey advise how family go take arrange demsef wen yawa no go dey for de new year. Today message of Hope say make we no carri hawa leg go whey trobo dey bikos God no dey happi with pipo wen dey waka yeye waka

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 31, 2025 29:00


    De kain tin dem wen woman wen get belle go do wen e go take bon beta pikin naim bi today mata. Today message of Hope say pesin wen dey so so tink bad bad tin na pesin wen dey do watin God hate bikos who tink bad tin go soon do bad tin.

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 30, 2025 29:00


    Wen hawa pikin dem get sef kontro e go make dem fit do watin dem plan and dem go fit bi beta pipo for kontree Today message of Hope say wen pesin kill anoda pesin with hin hand or hin mouth dat na sometin wen God hate.

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 29, 2025 29:00


    De way wen bad belle and vexnation dey close hawa hat so dat we no go fit hear God wen e dey tork naim bi today mata. Today message of Hope say anoda tin wen God no want na say make we no dey tork lie with hawa mouth.

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 28, 2025 29:00


    Hawa end of year praya na for safty for hawa soja dem, pipo wen dey travel and God favour for de new year wen dey come. Today message of Hope say eni pesin wen dey proud de carri shoda go up na pesin wen God no go fit forlow waka.

    Praise - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 27, 2025 29:00


    Today fess song say make we trust God and de sekond song say wen Jesus dey hawa life we go get peace even hinside wahala. De message of Hope say as we dey forlow God waka, devo no go fit do us enitin and God go open beta door wen blessing dey for we

    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 26, 2025 29:00


    Wen woman no kwik see huaband or e no even marray at all, pipo no go take beta eye look am for family and for communiti. Today message of Hope say God know who we bi whey we dey and how we dey forlow am waka and e know how to take bless us

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 25, 2025 29:00


    Anoda tin wen we go get as we dey redi to enta new year bi say we go commot from sin, pray and dey read hawa Bybbo Today message of Hope say make we forlow God and dey do watin e tell us like de pipo wen dey Philadephia church

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 24, 2025 29:00


    De way wen we go take know if pesin don do hawa small pikin bad tin and how we go take manage de mata naim bi today tork. Today message of Hope say make we forlow God waka as hin beta pikin even if odar pipo for church dey forlow devo waka.

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 23, 2025 29:00


    De way wen pesin go take kontro hinsef for watin e dey tink, tork and do naim bi de mata wen we start today. Today message of Hope say no mata how church pipo bad rish, God still get hin pipo wen dey do watin e tork and God dey bless dem.

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 22, 2025 29:00


    Wen pesin get bad belle, de bad belle go giam plenti wen doktor no go fit cure. Today message of Hope say make we no bi like de pipo wen dey Sardis, dem dey go church but dem no know God and God sef no know dem

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 21, 2025 29:00


    Today praya na for peace for hawa Ibo pipo and deir govment bikos of de mata wen niajiria govment take lock Nnamdi Kanu for prison De message of Hope say make God grace tish God pipo to commot deir hand for sin make God for fit bless dem

    Praise - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 20, 2025 29:00


    Hawa fess hymn today na "Just as I am" and de sekond hymn na "Jesus I come" Today message of Hope na de lesin wen say make we no desive odar pipo to forlow us serve juju bikos watin happun for Jezebel go fit happun if we no repent.

    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 19, 2025 29:00


    De wahala wen women wen no get pikin for marrage dey see and watin e fit do for de mata naim bi today tork. Today message of Hope say make we no bi like de pipo wen dey Pergamon church wen dey put one leg for church and de odar life for juju house

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 18, 2025 29:00


    As we dey wan enta de new year make we try get respet for hawasef and for odar pipo and make we get fait for God. Today message of Hope say make we no bi like de pipo for pegamon wen put one leg for church and put de odar leg for juju.

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 17, 2025 29:00


    De way wen we go take manage hawa kidni make e no go spoil naim bi today mata. Today message of Hope say make we bi like de pipo wen dey Symrna church wen hold Jesus kakaraka even wen devo and wicked pipo dey kill dem

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 16, 2025 29:00


    De kain wahala wen pikin dem go get wen dem no fit kontrol demsef as dem bodi dey do jigijigi naim bi today mata. Today message of Hope say God want make we come back come forlow am de way wen we forlow am wake wen we just give Jesus hawa life dat time.

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 15, 2025 29:00


    De bad belle wen pesin dey get fit ton to sometin wen go bite de pesin tomoro like Cain story for Bybbo, so make we no get bad belle. Today message of Hope dey tell us say God dey see and e know all watin we dey do

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 14, 2025 29:00


    Today praya na for all de pipo wen dey govment make God give dem beta hat and for God pipo and pastor for de North. De message of Hope dey tell us say de same message wen Jesus give de seven church for Revelashun naim e dey give us too.

    PCMLG_AWRx_20251213_7

    Play Episode Listen Later Dec 13, 2025 29:00


    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 12, 2025 29:00


    De kain wahala wen wife dey see wen e no kwik born pikin and watin e go do for dat kondishun naim bi today mata. Today message of Hope say wen we get de kain fait wen dey make God happi, yanfu-yanfu blessing dey boku for hawa life

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 11, 2025 29:00


    Man or woman wen no know watin e sorpose do as husband or wife, de one wen like shakis plus de one wen no dey pray na bad husband or wife. Today message of Hope say de wahala wen we dey see for life na de tin wen dey make hawa fait strong gidigba

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 10, 2025 29:00


    De tin wen fit burn pesin, watin we go do if pesin bodi burn and watin we go do wen no go let us see burn bodi naim bi today mata. Today message of Hope say hawa fait must strong and get patience so dat we go fit win devo for evry korna of hawa life

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 9, 2025 29:00


    De kain film, friends wen hawa pikin dem dey look and get dey watin dey make deir bodi dey do jigijigi. Today message of Hope say wen we dey do watin God tork, e dey make hawa fait dey strong and God go dey ansa hawa praya

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 8, 2025 29:00


    Wen pesin get bad belle de bad belle go fit make de pesin come get sikness wen doktor no go fit cure so make we troway bad belle. Today message of Hope dey tell us say na only fait wen we get go fit make God happi with us and make God ansa hawa praya.

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 7, 2025 29:00


    Today praya na for God to give hawa soja dem sense and pawa to take win de fite wen dem dey fite with bandit and boko haram. De message of Hope dey tell us say as life bi now we musto get fait if we tru-tru wan forlow God waka

    Praise - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 6, 2025 29:00


    Today fess song na "I'd rather have Jesus" and de sekond song na "Ancient Word" De message of Hope say make we believe God word bikos na only God word go fit save us from de devo wayo wen e dey take kill pipo

    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 5, 2025 29:00


    Pikin na sometin wen all woman want and wen pikin no dey e dey make woman no bi like woman. Today message of Hope say make we no let devo take sweet mouth desive us bikos no mata watin devo give us na hawa life e want scatar.

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 4, 2025 29:00


    Anoda kain pipo wen no bi beta husband and wife naim we tork for today. Today message of Hope say de road wen dey go hell get plenti sweet tin but make we rememba God word so dat devo no go desive us

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 3, 2025 29:00


    De kain tin wen dey fit make pesin piss for bodi and watin pesin go do to take commot dis wahala for body naim bi today mata. Today message of Hope say pesin wen no want enta devo trap and enta sin musto wish and run from enitin wen resembo sin

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 2, 2025 29:00


    De tin wen dey make hawa pikin dem bodi dey do jigijigi wen dey make dem do watin dem no sorpose do naim bi today mata. Today message of Hope dey tish us say devo get as e dey take desive pipo so make we shine hawa eye make we no fall hinside sin

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Dec 1, 2025 29:00


    De kain tin wen dey make bitaness dey for hinside family naim we don dey tork now. Today message of Hope dey tell us say na sin wen enta hawa life naim come change God plan wen e get for us wen e make us.

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 30, 2025 29:00


    Today praya na for all de wahala wen bandits and deir gang dey do for Nigeria and how God go take save us. De message of Hope dey tell us say sin bi like ashawo woman wen dey desive man enta sin.

    Praise - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 29, 2025 29:00


    Today fess song say na God dey give us hawa life as gift and de sekond song say Love go chnge hawa world Today message of Hope say na wen Jesus come again naim only hin go separate good pipo from bad pipo.

    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 28, 2025 29:00


    Woman wen marray anoda husband wen get pikin and hin sef get pikin plenti wahala dey dey dat kain family Today message of Hope dey tell us say de kain hat wen we get naim go let us fit hear God word and do watin e tork.

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 27, 2025 29:00


    Husband who wife wen dey tight hand no sabi give na one bad husband or wife wen we no sorpose bi. Today message of Hope dey tell us say wen we no do de tin wen make God put us for where we dey, dat one fit make God commot hand for hawa bodi

    Make pesin bodi well kankpe - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 26, 2025 29:00


    De tin wen mama dem go do wen deir small pikin no go get kro-kro for deir yansh naim bi today mata. Today message of Hope say today parabp dey tish us say wen we know watin God tork and we do as e tork we go bi wise and korret God servant.

    Pikin dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 25, 2025 29:00


    De tin wen pikin go see for hin bodi wen e go take know say e don dey ton to man or woman naim bi today mata. Today message of Hope say wen we do watin God tork we go bi like pesin wen build hin house for rock and de house no go fall lye-lye

    Family mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 24, 2025 29:00


    Wen dem sack man from hin work e no dey fit tell hin wife and wen de wife no dem go take am do sikrit wen odar pipo no go know. Today message of Hope say wen we give Jesus hawa life, we go bi lite like Jesus and we sorpose let hawa lite shine.

    Praya - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 23, 2025 29:00


    Today praya na say make God give kristian dem for de kontree hin Holy Spirit make dem bi like kristian dem wen dey de bybbo. De message of Hope say Jesus parabo abat new wine dey tish us say wen we give Jesus hawa life we sorpose change kon bi like Jesus

    Praise - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 22, 2025 29:00


    Today fess song say make notin enta hawa life wen go make us put God for numba two and de sekond song say Jesus naim bi hawa shepherd De message of Hope say notin wen we get for dis life go fit beta pass de life wen God go give us for heaven

    Woman dem mata - God word wen we dey take grow

    Play Episode Listen Later Nov 21, 2025 29:00


    Wen woman marray anoda husband bikos hin fess marrage scata or hin husband die, plenti wahala dey dey dat mata. Today message of Hope say even hawa life if e no dey God hand no bi sometin wen we go fit put hawa hope.

    Claim AWR- Voice wen dey ginger Hope

    In order to claim this podcast we'll send an email to with a verification link. Simply click the link and you will be able to edit tags, request a refresh, and other features to take control of your podcast page!

    Claim Cancel