AWR Pidgin English

Anoda tin husband and wife wen want trust for deir marrage again go do na say dem no go do watin scata deir marrage again. Today message of Hope say wen de Holy Spirit pawa enta hawa life, we go change and we go begin waka as God want make we waka.

Today praya na to tank God as e bring copa dem from kidnapa hand and make God epp protect all hawa copa dem as dem dey serve deir kontree. De message of Hope say God pikin dem go get pawa wen Holy Spirit enta deir life and dem go fit forlow God waka well.

Today fess song na "Sweet hour of Praya" and de sekond song na "My fait look up to thee". De message of Hope show us pipo for bybbo wen pray and God ansa deir praya and na dem bi hawa exampo wen we go take learn how to pray.

Today kweshun na weda Kristian sorpose dey drink shakis and de ansa na say God no want make we drink shakis. De message of Hope say if sin dey hawa life and we dey take sakam eye dey look God word, God no go hear hawa praya,

Today lesin wen Abram tish us na say make we rememba say na God dey epp us so make we dey give Gow watin bi God own. De message of Hope say make we get fait say God dey hear hawa praya as we dey pray and e go ansa wen de time rish.

Watin fit happun wen go make woman go commot belle and e no do am for hospita and de wahala wen dis one dey bring naim bi today mata. Today message of Hope say wen we dey pray make we rememba to pray make God do watin e plan for hawa life for us.

De kain tin wen go happun for pikin life if na pikin wen dey get long troat naim bi today mata. Today message of Hope say God want make we ask am for de tin dem wen we want make e do for we but we must get Jesus for hawa life and dey do watin God tork

Anoda tin wen we go take put trust for hawa family after we scata am bi say we go commot vexnation and we go forgive. Today message of Hope dey tell us say de praya wen God go ansa na praya wen pesin take fait pray bikos fait dey make God happi.

Today praya na for hawa pikin dem as dem go stat skool, for God to give papa and mama moni,for ticha and odar pipo for skool. De message of Hope dey tell us say praya na make we forlow God tork as we dey forlow hawa friend tork.

Today fess song say hawa fait dey look Jesus and de sekond song say na fait naim we take reach whey we dey now and naim we take forlow God waka. De message of Hope say make we put God word for hawa hat so dat hawa fait go grow and hawa fait go strong.

De kweshun of watin pesin go do wen de pipo wen hin do good for bifor come dey do am bad now bikos e no get moni again naim bi today mata. Today message of Hope say if hawa praya no get fait God no go fit ansa de praya.

Today we see say Abram go fite war so dat e go fit save Lot and hin propati, make we sef learn to dey epp hawa pipo. De message of Hope say we musto put fait for hawa praya and we no go get two mind if we tru-tru want make God ansa hawa praya

Today sikness na lassa feva, one sikness wen dey dey hinside rat shit and piss and wen pesin fit get if rat piss or shit torsh food, plate or odar tins. De message of Hope say fait na hawa bullet proof wen we dey forlow devo fite

De tin wen dey make pikin and odar pipo dey get long troat naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say na fait we dey take win de fite wen devo dey forlow us fite and even de fite wen we dey fite to commot for sin.

Wen we want build trust again for marrage we must redi to tork de trut so dat de pesin wen dey vex go know how e go take forgive us. Today message of Hope dey show us pipo for bybbo wen get fait wen we go fit forlow deir esampo and do as dem do.

Today praya na for de tins dem wen una say make we pray for and we pray for fama wen fulani scata deir farm and pipo wen want make God heal dem. De message of Hope dey tell us say we must get fait if we tru-tru wan forlow God waka.

Today two song na de same song wen differen pipo sing and de message na say e no go tay again, Jesus go come. De message of Hope say make we stand strong make we no let hawa fait die bikos Jesus go come e no go tay again.

De tin wen Jesus want make we know for hinside Matthew 6:33 naim bi de kweshun wen we ansa today. Today message of Hope say wen Jesus come evrybodi go see am, hin coe no go bi sekrit mata and e go take us go hin kindom.

Today lesin for Abram na say make we no carri shoda go up and make we bi pipo wen dey make peace wen wahala dey. De message of Hope say Jesus tell hin discipo say soja dem go scatar Jerusalem and pipo go desive odar pipo say hin don come wen he neva come.

Meningitis wen bi sikness wen de spoil brain and de do pikin dem pass naim bi today mata. Today message of Hope say wayo Jesus dem go come wen devo go use take desive pipo bifor Jesus go come so make we shine hawa eye.

De way wen pikin go take happi even wen e see odar pipo wen beta pass am naim bi today mata. Today message of Hope say bifor Jesus go come sin go brekete for life but God pipo must stay as God want make dem stay.

Wen trust scatar bicos bad tin happun, de husband and wife must try waka pass dat bad tin make marrage for no scatar. De message of Hope say bifor Jesus go come mani wayo profet, war, hunga sikness go dey so make we redi bicos Jesus go soon come.

Today praya na for hawa family, make God epp husband love deir wife and make wife respet deir husband and make dem train deir pikin well. De message of Hope dey tell us say Jesus go come again and Jesus tell us all de sign we go see bifor Jesus come.

Today fess song say na God dey lead us and de sekong song na praya make God dey hawa life so dat we no go waka leave God. De message of Hope say make we no dey believe devo lie but make we believe God word for evrytin wen konsign us.

Watin man wen hin wife sorpose know and do bifor e go marray anoda woman naim bi today mata. Today message of Hope say devo get sweet mout wen e dey take desive people like e desive eve so make we put God word for hawa hat.

Today lesin bi say God na beta papa and e no dey beat us for watin we no know and watin we neva understand. De message of Hope say God no want make we go hell naim make Jesus die for we and naim make God give us hin word.

Ten tins wen pesin go do for hin life wen he go take get beta life wen sikness no go dey enta hin bodi. De message of Hope say even pipo wen dey for church dey work for devo so make we try shine hawa eye with God word so devo no go desive us.

De kain life wen pikin wen dey dodge skool go get and de kain tin wen go happun for hin life naim bi today mata. Today message of Hope say na papa naim get de work to take advise hin pikin make he waka well for life so make papa train pikin to forlow God

De lass tin wen fit scatar trust for marrage na wen husband and wife dey play itch odar wayo, so make we no play wayo. Today message of Hope say wen we kip God word for hawa hat and do watin God tork we no go waka de road wen dey carri pipo go hell.

Today praya na make God kip us safe as we dey waka and travo for hawa road dem. Today message of Hope dey show us de road wen pesin go waka wen go carri am go hell fire and God no want make we waka dat road.

Today fess song say God dey make hawa life fine wen we give am hawa life and de sekond song say we bi new pipo wen we give Jesus hawa life. De message of Hope say as we give Jesus hawa life and de read hin word, we dey learn how we go take bi like Jesus

Woman wen want make pipo take beta eye look am go dey dress well and e no go lazy plus e go know de kain pipo wen e go forlow waka. Today message of Hope say wen we give Jesus hawa life God go give us de pawa wen we go take forlow waka as hin pikin

Anoda lesin for Abram life bi say make we dey ask God bifor we do enitin and make we no dey torl lie. Today message of Hope say as we don give Jesus hawa life, make we dey go church dey forlow odar kristian dem waka bikos na so we go take grow.

De kain wahala wen worri go give us and watin we go do make we no for worri naim bi today mata. Today message of Hope say na only as we dey hear God word and do watin e tork naim hawa karacta go change and hawa lite go shine.

De tin dem wen dey make pikin dey dodge skool and dey do yeye tin naim bi today mata. Today message of Hope say as we dey grow for hinside God word, sin go commot for hawa life and hawa new life go bi like new dress wen pipo see us.

Trust go dey marrage if de pipo wen dey de marrage tork watin dem fit do and dem do watin dem tork. De message of Hope say as pikin wen we bon dey chop dey big na so God want make we sef chop hin word so dat we go grow big.

Today praya konsign praya rekwest dem wen we get wen konsign make God heal pipo wen dey sik and make God epp jorge Adamu case well. De message of Hope say for pesin to bi beta kristian, God Spirit must bon de pesin and den de pesin go baptise.

Today fess song say we no go commot God love for hawa life and de sekond song say make we love hawa neibor. De message of Hope say God save us and e kip us for here so dat we go take care of de tins wen konsign God.

Anoda tin wen go make woman bi beta woman na say make e no bi de kain woman wen evrybodi dey take make yeye Today message of Hope say as God pikin we sorpose get de kain sorri hat wen Jesus get so dat we go dey fit do good as Jesus do.

De lesin for Abram life today na de waka wen Abran forlow God wake wen make am fit hear and do watin God tell am to do. Today message of Hope na de stori wen Jesus tork abat de good samaritan wen e take tell us who hawa neibor bi tru-tru.

Small small tins dem wen pesin fit do wen go epp am sleep well naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say Jesus redi to ansa all hawa kweshion wen konsign how we go take get eterna life and e no dey taya to forlow us tork.

De kain way wen pikin take dey dodge skool and dey take do watin e no sorpose do naim bi today mata. Today message of Hope dey tell us say God want make we no only hear hin word bu tmake we do watin hin word tork.